Mikel Oyarzabal late second half goal help Spain defeat England for di final of Euro 2024 to become champions of Europe.
La Roja dig deep to overcome di late push from England following Cole Palmer equaliser on 73 minutes.
Spain bin take di lead minutes afta di restart through Nico Williams cool finish into di bottom corner.
England players fight well to stay in a game wey dem largely play as do second best team, anoda defeat in a final don see dem lose back to back Euro final afta dem lose to Italy on penalties for Euro 2020.
For Spain, dis na anoda crown to dia head as na dem don win di most European titles now – four.
Dis time dem do am wit excellence as dem win all dia seven matches en route to di title becoming di first European team to do so.
90+5 – Spain hold on to defeat England 2-1.
90+2 – Yellow card for Watkins.
89 mins – Rice denied, di midfielder header from a corner dey saved by Simon. E rebound go wide.
89 mins – England send on Ivan Toney in place of Foden. Spain also make substitutiton, Merino replace Yamal.
87 mins – Spain retake di lead through Oyarzabal.
83 mins – Spain remove Le Normand from di match, dem replace am wit Nacho Fernandez.
82 mins – Lamine Yamal again test Pickford wit shot from just inside di box. Di England goalkeeper use strong hand push am away from goal.
79 mins – Spain win cornerkick wey England deal wit well.
73 mins – Substitute Cole Palmer equalise for England!
Di Chelsea man fire e shot low into di corner afta e receive one touch pass form Bellingham.
70 mins – Ruiz try e luck from distance, di ball just dey rise like garri. E no trouble Pickford.
69 mins – Spain take off Morata, Oyarzabal na im replace am.
66 mins – Good save! Pickford dive low to keep out Lamine Yamal shot from going in.
64 mins – Jude Bellingham try to bend one into di net afta e turn e marker nicely, e shot go wide of Unai Simon post.
61 mins – England make substitution as captain Harry Kane don leave di match. Ollie Watkins wey score di winner for di semi-final against Netherlands don come on.
56 mins – Nico Williams again nearly increas Spain lead, e shot go narrowly wide. England never really do much for dis second half.
53 mins – Jone Stones become di second England player to receive yellow card for dis match.
49 mins – Spain almost score a second. But dis time Olmo drag e shot just wide of Pickford post.
47 mins – Spain take di lead! Williams fire di ball low into di corner afta e receive Yamal through ball.
46 mins – Di second half between Spain v England don resume.
Spain make early second half change. Martin Zubimendi don come on for Rodri. E never dey clear why but e fit be injury.
Di players don begin return to di Olympiastadion pitch to start di second half. So far, no much chances don dey for dis Euro 2024 final.
Half Time: Spain 0-0 England
45+2 mins – Unai Simon finally dey involved in dis game. Di goalkeeper stoop low to catch Foden volley from a cross. Dat go be di last action of dis quiet first half.
43 mins – Spain win anoda cornerkick through Morata run into England box. Yet again, di cornerkick dey cleared by di Three Lions defenders.
39 mins – England never really get enough of di ball as dem go want for dis first half, Spain dey press dem high wit not enough space for dem to create anytin.
35 mins – Spain win back to back cornerkicks but both times nothing come out.
31 mins – Yellow card for Olmo becos e catch Declan Rice for stomach wit e boot.
28 mins – Fabian Ruiz shoot di game first shot on target, e no trouble di Pickford for England goal becos e take deflection from Guehi.
25 mins – Yellow card for England captain Harry Kane. Di striker boot catch Ruiz late. Dat na di first yellow card for dis game.
23 mins – Yamal try to find space inside di England box, di 17-year-old shot take deflection go out for corner. Di cornerkick no trouble England.
21 mins – Cucurella bring down Foden to concede foul against Spain.
16 mins – Walker race into Spain eighteen, e cross di ball across goal but di men in red clear am out for corner. Spain deal with di corner from Saka well.
15 mins – Spain marking na helele, three Spanish players track back only to provide cover and stop Bellingham from breaking free.
11 mins – Bellingham win a freekick inside Spain half. Shaw send a cross in from di spotkick, no better chance present imsef becos Guehi foul im marker.
8 mins – Spain try to play short passes into di danger area, Rice read am well come snuff out di danger.
5 mins – England deal wit di corner kick well as dem clear di ball out.
4 mins – Spain so far dey in control of possession dis early for di game. Williams swing in cross into England eighteen yeard box, Stones clear out for corner kick.
1 min – England don take di opening kick of dis Euro 2024 final.
Di closing serenre don finish, now time for serious business. Spain vs England dey about to start and BBC Pidgin go update you live as e dey happun.
Spain XI: Simon; Carvajal, Le Normand, Laporte, Cucurella; Rodri, Ruiz, Olmo; Williams, Yamal, Morata.
England XI: Pickford; Walker, Stones, Guehi; Shaw, Rice, Mainoo, Saka; Foden, Bellingham, Kane.
After three successful series, which have already resulted in two BAFTA nominations and a baby, MAFS UK is back for a fourth. E4 says the new series pr
The 34-year-old, who rose to fame on ITV’s The Only Way Is Essex, launched her own reality series titled First Time Mum in 2017 – which was later renamed M
For free real time breaking news alerts sent straight to your inbox sign up to our breaking news emailsSign up to our free breaking news emailsSign up to our fr
The record is the former Pink Floyd guitarist’s third number one album after 2015’s Rattle That Lock and 2006’s On An Island. Luck and Strange also tops