Wia dis foto come from, Reuters
Some airports for Manchester, Liverpool John Lennon and Birmingham don close dia runways – wia aeroplane land and take off- sake of heavy snow overnight.
Dem dey work to stop dis disruption “as quickly as possible”
Temperatures bin fall to -11C overnight for Loch Glascarnoch, Scotland, UK wey dey also experience power cuts afta heavy snow.
Severe weather alert dey in place as 25cm of snow fit fall on roads for parts of northern England, na wetin National Highways tok.
Two amber warnings for heavy snow and ice still dey in place for parts of England, Scotland and Wales, wey fit cause travel delays and power cuts for some places.
Wia dis foto come from, EPA
Di weather condition no only affect airports but rail stations as well. Passengers wey dey travel wit train on Sunday fit face disruption, na wetin National Rail tok.
Great Western Railway dey currently affected by poor weather, sake of di heavy snow wey dey kontinu to affect di road network for Wiltshire area wey mean rail replacement buses no dey able to serve Westbury Station currently.
Dem close di station since 27 December and dem go reopen am on 23 January to allow Network Rail to carry out improvements to di track for di area.
Poor weather dey currently affect various routes as Northern, ScotRail and TransPennine Express services fit also dey affected.
Some operators still dey manage di impact of weather issues from early last week.
Dem don put speed restrictions and line closures due to ice and snow as measures wey di operator fit use to make sure say trains fit kontinu to run safely.
While planes dey designed to deal wit tins like snow and ice, fog and high winds, air traffic control dey put strict safety limits for dis type of situations.
As a result, “airports go into some kain slow motion” wit di spacing between arriving and departing aircraft increased, na wetin travel expert Simon Calder tok.
Wia dis foto come from, PA
Di National Grid dey manage a number of power cuts since morning across di Midlands, South West and for Wales.
At least 113 properties no get light for Derby, 130 for postcode close to Weston-Super-Mare, 82 for Newport and 28 for Birmingham.
Di National Grid estimate to dey able to resolve di majority soon.
Wia dis foto come from, PA Media
Fot di south, snow dey across di south western counties of England, central southern England and Wales and even across Sussex, Surrey and Kent – especially over di high ground.
Temperatures dey between 13C in Yeovilton for Somerset. Di rain for di south go kontinu on and off through di day wit winds for channel coasts and East Anglia.
Snow still dey fall across northern England and north Wales wia high accumulations dey particularly over di higher ground of di Pennines – as much as 30-40cm.
Di amber warning for snow and ice dey trimmed towards di south but still include di North Midlands, East Midlands, di Liverpool Bay Area and north Wales. Small risk of some freezing rain within dis area still dey, warn fit expire warning for afternoon.
Wia dis foto come from, BBC Weather Watchers/KakigoriPhotography
Wia dis foto come from, PA Media
Wia dis foto come from, BBC Weather Watchers/Fay Fautley
Wia dis foto come from, Image source,BBC Weather Watchers/Motown Mark
Wia dis foto come from, BBC Weather Watchers/Dafydd and Susy
Currently, traveling between Newquay and Falmouth by train involves quite the hassle due to the lack of a direct rail link.The £56.8 million project is set to
Regarding relaxing getaways to enjoy a slower pace, the UK has no shortage of villages and towns that offer the ideal places to unwind.Among them, one Scottis
Areas across Chile are affected following the power outageNewsTom Burnett Content Editor00:58, 26 Feb 2025Updated 00:59, 26 Feb 2025Santiago in Chile(Image: Get
A new survey has revealed the worst airline, with one Belfast woman describing her experience with the carrier as “dreadful” - and it’s not one of the che